32.4 C
Bangkok
Tuesday, April 30, 2024

Thailand lion video: Owner of lion wey dey cruise inside open-top Bentley chop arrest


Police for Thailand don arrest one woman wey her pet lion dey for video as dem dey go joyride for di streets of Pattaya.

One video wey don go viral show di chained lion cub as e sidon for back of one white, open-top Bentley.

Na one Sri Lankan man wey currently don comot di kontri dey drive di lion around, belief be say di man na friend of di woman, Sawangjit Kosoongnern.

While e no be illegal tin to own lion for Thailand, e need dey officially registered.

Authorities for Thailand say Sawangjit claim say she bin buy di animal from one Thai man for Nakhon Pathom province, wey successfully facilitate im delivery to Pattaya.

However e bin fail to get im facility checked by officials bifor e do so, dis one make both di transfer and ownership of di animal illegal.

She therefore dey face charges say she possess one controlled wild animal witout permission, wey carry penalty of one year imprisonment and fine of up to 100,000 baht ($2,800; £2,200).

Police bin reportedly plan to charge di Sri Lankan man, wey bin keep di lion for im rented pool villa, but dem no fit charge am as di man no dey Thailand again.

Wetin we call dis Video,

Thailand: Lion video as e dey ride for open-top Bentley

Dem bin wan charge am wit bringing a controlled wild animal into public places, wey carry jail time of up to six months and a fine of 50,000 baht.

Di man wey bin sell di lion to Sawangjit go also face charges say e move animal witout permission.

Officials say currently na 224 lions dey for Thailand wey dey legally owned.



Read more…

Latest Articles